DEM DON BURY GEORGE FLOYD AGAIN FOR IMO STATE. DEM SAY NA DIA 'KINSMAN' Pictures dey flow online about how dem take re-bury George Floyd, di black American man wey policeman kill for America wey make protest tear full everywhere for di country and even worldwide. As di facebook post gist di gist... "We don re-bury George Floyd for Mbaise, Imo State. Dis mata happen unto how one Pastor Humble Okoro say na from Mbaise George Floyd from come According to wetin Pastor Okoro tok, "I don trace George Obinna Floyd say na from Umuoffor kindred for inside Obokwu obibi Aboh, Mbaise Imo State and I dey very hapi say i don bury am wit im ancestors dem. .