REAL MATTAZ: HUBAND AND WIFE OVER BEAT DIA HOUSEBOY UNTOP N100 AKARA
Operatives wey dey Orji Divisional Headwuaters for Imo state Police Command don arrest one couple, Mr Goodluck and Mrs Benita Ogbuji unto say dem torture dia eight years old house boy wey Im name bi Wisdom unto N100 akara.
Two news pipo, Chidiebube Okeoma and Harriet Ijeomo wey carry Policemen go dia house for Umudagu Mbieri inside Mbaitoli Local Government yarn say di couple use beating finish di small boy becos im buy N100 akara instead of N50 own.
Okeoma yarn say, "We get informate say di couple over beat di boy, dem even almost kill am join unto say di boy buy N100 akara instead of N50 own. We ask question for social media wey make us sabi dia address. We con send Policemen go di place early momo on Thursday as we arrest di wicked couple and rescue di boy."
"Dey don detain dem for Orji Police Station, and Police dey take care of di boy. The level of wound wey dey di boy bodi no b here o. We dey find justice for di boy. We want make dem judge di couple. Dem bin don comot di boy from school since 2019. For inside Police station, di wife of di man con dey beg say na devil work o, na devil run di show ans she regret am."
Di interim Management Committee Chairman of Ohazi/Egebma LGA, Marcel Amadioha wey di boy come from say dem gey interest for di case.
Police don yarn say dem dey ontop di mata and dem go handle am well.

Comments
Post a Comment