Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.





Na di third time bi dis wey Governor Dapo Abiodun of Ogun state go add join di 'eased lockdown' for di state to make dem fit reduce as corona virus dey spread.

Abiodun tok am on friday say di new days wey dem add join go start for May 25th na unto as pipo no gree hear word wey government bin dey yarn dem.

Im tok say after dem don look di mata well, na im make dem take action say di 'eased lockdown' go still continue till Sunday, May 31st, 2020.

Im took say, as dem dey try make everytin for balance, dem go open everywia make pipo for move from 7am go reach 5pm on Monday, 25th May, 2020; Wednesday, 27th May, 2020 plus join Friday, 29th May, 2020.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.