Posts

Naija Chess Odogwu don break world record

Image
 For inside dis week so, plenty tins don happen, One of di beta tins wey sweet Naija pipo belle dis week na how Naija Chess Odogwu, Tunde Onakoye don break world record of di person wey play chess for di longest time.   Tunde Onakoya. Di record wey him bin set na to break di one wey bin dey ground before as him decide say him wan play Chess for 58 hours, no sleep, no leave and no transfer. Him get di opportunity to play wit Ogbone Chess Player for New York City for America, Shawn Martinez. As e bi say Guniess Record get dia own rules, na only Martinez and Onakoya game dem count as every oda person wey com play bi like who stroll come as na master to master game dem dey count. Di record now dey for two of dem as dem play for 60hours  and dem don become di longest players wey play Chess pass for di whole world. Dis Mata no bi say Tunde Onakoya jus wake up say him wan run dis Mata. Part of di Jinja bi say him wan use di awareness raise $1million dollars for Charity to take e...

Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal

Image
 Christiano Ronaldo always dey dey happy wen e dey play for Portugal and im problem for Manchester United no go affect dia hope for world cup naim teammate Joao Mario yarn dis one. Di superstar wey blast Manchester United for interview wey im do before world cup start tok say, di club fall im hand and im no get any respect for Man-U manger, Erik ten hag. Ronaldo wey bi 37 years don readi to lead Portugal for di world cup  wey dey happen for Qatar and e bi like say naim last world cup bi dis. Ronaldo dey always dey happy wen e dey National team Joao Mario wey bi Benfica midfielder tell Reuters afta dia tainig for Lisbon. "I see am yesterday and e dey very fine as e sey always dey" e even tell me say "im happy to dey here" and im focus na on di national team

2022 don enter

Image
 As new year enter so, e go make beta sense make we dey run tins wit style wey make sense make di result wey we go get for beta pass last year own. Pidgin-news bin go sabbatical. But we don resume finally now. No shaking my people.

EL-RUFAI DON YARN SAY IM NOR GO CHANGE MOUTH O, SAY IM WAN MAKE PRESIDENCY GO TO SOUTH PIPO FOR 2023.

Image
Di Governor of Kaduna, Nasir El-Rufai don yarn on Sunday say im no go change mouth unto mata of 2023 presidency wey im tink say suppose enter south pipo of Naija hand. El-Rufai wey yarn wit Channels TV untop dia Sunday Politics show yarn say base on arrangement, afta President Muhammadu Buhari, presidency suppose shift go South. Im still yarn say, even Peoples Democratic Party, PDP, get dat kain arrangement to rotate power na why after Olusegun Obasanjo run Im own finish, Late Umaru Musa Yar'adua enta. Im yarn say nor bi say im go support north or south persin but di truth bi say, power need to shift go south for 2023 even though dat kain tin nor dey inside APC constitution. "After Buhari, wetin go makes sense for north politicians na to support candidate for south. I nor get believe for zoning but na my mind i jus yarn so. We bin don get arrangement like dis make we maintain am. "I no believe say any side for Naija get right say na dem must dey p...

Azubuike Ekwegbalu: Unknown men Dem don kill Gov. Obaino aid

Image
Hon Azubuike Ekwegbalu wet bi Senior Special assist (SSA) to governor of Anambra state, Governor Willie Obiano for untop security mata don die. Na so Igbere TV hear am. Na yesterday nite dem kill am. According di gist wey reach IgbereTV hand, Some men wey dem neva know kill Ekwegbalu for inside commissioner's quarters for Awka. Ekwegbalu bin come from Ogbunike for Oyi local government and im bi younger broda of do governor wife. Di way wet di mata take happen still get as e dey wen we dey write dis gist.

WOMAN PARA FINISH FOR MINNA UNTO SAY HER BOYFRIEND NOR TELL HER SAY IM DON MARRY WIT THREE PIKIN

Image
One woman for minna wey nor know say her boyfriend don marry don enta facebook dey threaten di man. She log in for di man facebook account con write RIP for di pishur of di man wey im name bi Chijioke and di pishur of im family too say dem don die. For wetin she yarn, she say, "I go kill all im family pipo and im go frustrate di way i frustrate so". She say she don abort for Chijioke two times and she nor know say di guy get wife and children for anoda place.

AJIMOBI ENTA HEAVEN- NA WETIN IM WIFE YARN BI DAT

Image
Florence, wey bi wife of late Oyo governor, Abiola Ajimobi, yarn say her husband dey for heaven. Di widow yarn did mata on Sunday for inside Oluyole, Ibadan. Florence yarn dis mata unto how Nigeria Union of Journalists (NUJ) leaders for Oyo state visit am. Di waka wey dia Chairman, Ademola Babalola lead go her house to greet her for Eid-el Kabir. Di before before First Lady say she miss everytin about her husband wey she yarn say bi her strength and number one supporter. She say Ajomobi live life wey dey fulfilled, say still yarn say, "Wetin man go gain of im reach 90 years and still nor reach heaven?" She say,  "Ajimobi enter heaven and di guy don settle wit God. Na my greatest consolation bi dat. Na my joy bi dat. I dey cry and feel bad becos I miss am." "Dis na becos if you dey di mind of pipo wey you love, e mean say, you live forever. Make God epp us, everytin wey im don achieve for Oyo state and Nigeria go live on fo...