Naija Chess Odogwu don break world record
For inside dis week so, plenty tins don happen,
One of di beta tins wey sweet Naija pipo belle dis week na how Naija Chess Odogwu, Tunde Onakoye don break world record of di person wey play chess for di longest time.
Tunde Onakoya.
Di record wey him bin set na to break di one wey bin dey ground before as him decide say him wan play Chess for 58 hours, no sleep, no leave and no transfer.
Him get di opportunity to play wit Ogbone Chess Player for New York City for America, Shawn Martinez.
As e bi say Guniess Record get dia own rules, na only Martinez and Onakoya game dem count as every oda person wey com play bi like who stroll come as na master to master game dem dey count.
Di record now dey for two of dem as dem play for 60hours and dem don become di longest players wey play Chess pass for di whole world.
Dis Mata no bi say Tunde Onakoya jus wake up say him wan run dis Mata. Part of di Jinja bi say him wan use di awareness raise $1million dollars for Charity to take epp millions of Children across Africa as him don dey do before.
Shawn MartinezDis na big one for Naija pipo as well as di whole Africa.
Congratulations Tunde, We dey your back!


Comments
Post a Comment