Posts

Showing posts from May, 2020

Ekiti govenment don increase waka days to 5

Image
Di government of Ekiti State don increase di number of days wey pipo fit move around for di state from three days enta five days. Dem yarn did mata so thru di state government official verified twitter handle dis evening so. Full gist dey below:

Police arrest 11 pipo unto say den rape 12 years old pikin

Image
Di police command for Jigawa don arrest 11 suspect unto say dem rape 12 year old girl (dem no gree release di girl name) Di Man wey dey speak for di command, SP Abdu Jinjiri don confam say dem arrest dem tru tru Jinjiri yarn say di suspects dem (dem no free tok dia names) don enta police hand on May 30, for inside Dutse Local government for Jigawa state. E explain say dem arrest di suspects after dem hear complain say of of dem, wey bi 57 years old wey dey Ma'ai village enter Limawa market as dem see am say e dey try to scope di girl make e for fit go rape. Jinjiri tok say as investigation dey roll, di girl mention 11 names, and na di names dem take arrest di pipo we dem arrest so. Touch lighting of di mata still dey continue.

Unknown men don rape and kill 22 year old lady foe benin

Image
Wahala tear for Benin on Wednesday, 27th May as some men wey dem neva know rape and still con wound a 22 year old girl wey her name bi Uwa inside Redeemed Christian Church of God province 10, ikpoba hill, Benin city. As we see do mata, e happen say di lady dey always dey go church to go read, and di security man wey dey di church say, dat time, im comot go collect church key from di pipo wey hold am. Wen e reach dia, e see say di church don already open, as e enter, e see di young lady dey ground, blood full her bodi and fire extinguisher can wey dem take beat am near her dia. E say na so im run go wia e carry key o, di key holder and im wife run follow am reach dia. Dem bin tink say di girl don die but she shake her hand, na im dem quickly rush am go Uniben Teaching hospital, na dia she tok say dem rape am before she con die las las.

Shehu Sani don use proverb reason Buhari matter

Image
Shehu Sani wey dey part of the 8th Assembly don yarn sometin wit him twitter account. E get as di mata bi so you go need to use your personal mind reason am.

Pipo for Ukwulu community don dey sing lamentation as Fulani herdsmen dey worry dem

Image
Ukwulu community for Dunukofia LGA inside Anambra don dey cry as  Fulani herdsmen don use dia cows destroy farms for dia. See some pictures wey channels TV show.

Fire don burst Olaleye market for Shomolu inaide Lagos

Image
Pipo wey dey live for shomolu for Lagos no fit sleep last night o, as fire wey burst Olaleye market no gree dem. Punch hear am say na for 3am di fire start, e burn market wey go reach billions of naira. Till now, dem never still know wetin cause am. No body die for di mata. Officers of Lagos State Emergency Management Agency and di Federal Fire service don reach di place so. Persin wey dey yarn for LASEMA tok say, "As dem reach, dem see say Olaleye market don burst wit fire" "As e dey so, we still dey touch light di mata to know how di fire start". " Market wey reach billions of naira don kpafuka so but nobodi die for di mata" Na punchonline.com did mata from come

Afenifere yarn say Buhari make Naija Headoffice of poverty

Image
Di Yoruba group wey dem call Afenifere don yarn on Friday say, Muhamadu Buhari administration son turn Naija to head office of poverty since im don't dey presidio for five years now. As dem dey try give di administration mark so, aay dem no try at all, Yinka Odumakin wey bi di National Publicity Secretary for dem say, even as no bi five years ago Naija problems start, APC adminstration do multiply am. Im yarn say, di way di tin bi, e bi like say we still dey military rule and no bi democracy cos did government don rewind us go back and we no see any development mata. Pipo no gain anytin for did five years so, as di guy yarn. We no fit use propaganda run show to make country beta.

Lagos State wan spread land ontop water.

Image
Make dem for fit increase di available house and infrastructure for di state, di Lagos State Government don yarn say dem go build more man-made island near all I'm water for inside di whole Lagos state Di Honourable Commissioner for Waterfront Insfrastructure Develipment, Arch. Ahmed Kabiru Abdullahi, don yarn today for di 2020 Ministerial Press Briefing for JJT Park wey dey Alausa, Ikeja, to mark as e don complete one year wey Governor Babajide Sanwoolu start I'm government. Di commissioner tok say work don begin to take collect bacjk 100 hectares of land wey dem propose for mixed-use development wey dem call '' Osita Islands'', wey dey beside Orange Island for Eti-Osa Local Government Area so. Abdullahi still yarn say approval don dey to collect back 54.58 hectares for Makoko for redevelopment, as Majidun-Awori Island project go start make dem use am bring commercial and residential real estate development mata come Ikorodu side As I'm dey yarn say di work...

Lagos state don release 87 Covid-19 patients today.

Image
#COVID19 Update as di incident commander wet bi Governor @jidesanwoolu yarn for twitter. My beta Lagos pipo. I bring beta news from our isolation centres dem. Today, we don free 87 pipo wey don fully recover from #COVID 19 make dem enta town free as den like. Men bi 47 and women bi 40 and all of dem bi we Naija pipo.

Zlatan Ibile don show im pikin face

Image
Zlatan ibile don share im pikin pishur las las. As today na children's day, e say make e nak us some fine pishur and video of di fine pikin. Video dey too... https://www.youtube.com/watch?v=uAd98oibJI4

Actreas Omotola Jolade Ekehinde don yarn say she don go back to music o

Image
Ogbonge Actress, Omotola Jolade Ekehinde don yarn am say, music na im dey her eye now o and no gate wey dey hell go fit stop am so.

Davido don stretch hand give Cynthia Morgan

Image
Omo baba olowo, wey we know as Davido, don reach out to Cynthia Morgan dis afternoon thru im twitter page. Davido tok say make Cynthia Morgan call am, say e get song wey dey ground now, im wan go sing im own part so.

Cynthia Morgan nor resemble her again

Image
We hear am say Cynthia Morgan get quarrel wit her record label (wey Jude Okoye, P-square senior broda own) She lose her royalty, her stage name wey bi her real name, plus join here vevo account. She dey depressed so and she no even bi like di Cynthia Morgan wey we bin know dat year.

Peter Okoye, Mr P don chuk mouth for di Cynthia Morgan gist wey dey ground so

Image
Peter Okoye wey don change im name to Mr P, after P-square don separate don tok im mind for di mata wey dey ground so. Na for twitter di guy pour am out make we for see as e bi.

Buhari greet all di muslim dem as Ramadan finish.

Image
Buhari yarn for im twitter handle @mbuhari say; As we dey celebrate say Ramadan don finish so and we dey do Eid-el-Fitr, we still dey careful cos of wetin dey happen. Make we continue to dey reason on di beta tins wey of di season, make dem dey wit us even after di season don pass. I wish all of una Eid Mubarak.

Ontop Cynthia Morgan matter: May D sef don yarn im own.

Image
Dis gist of how Cynthia Morgan don lost everything including her stage name don berekete full social media as one lady follow am do live chat yesterday for Instagram.. Na on top dis mata make MayD response as one twitter user 'AURACOOL" speak im mind say persin Neva really progress from P-square dem side through music. Anoda twitter user say May D bin greedy, May D set no gree o, E reply di guy back. Di tweets dem dey below.

BRT fit stop work from May 25.

Image
Primero Transport Services Ltd, wey dey operate Bus Rapid Transit (BRT) fit stop work on May 25, as den get small waka waka problem, as confirm informant yarn on Friday. All di wahala to take get di oga patapata for di company, Fola Tinubu make e for relate about wetin dey happen no work. For May, 15, NAN yarn say BRT bus wey dey different junction dey go different areas no reach as e dey before as pipo wey dey wait for line long pass before. Pipo wey dey use BRT don dey complain as BRT no reach since governent don allow pipo waka go out since May, 4. Tinubu yarn for May 15 say, di way wey dem dey operate now wan bi like say dem jus dey do work wey no pay dem. "To dey carry 20 pipo inside dat kain bus no go work as dem no dey see gain again so. Pipo wey we dey owe no gree leave us for neck, as e dey now, di mata no go work. Na why we don less di number of bus wey dey town." Lagos state government bin don yarn say make di bus wey bin dey carry 70 pipo dey carry 21 now.

Buhari don give power of freehand to state Legislature and Judiciary

Image
Di gist come from  President Muhamadu Buhari twitter handle wey e yarn say, according to wia im power reach, im don't grant dem freehand wey oyinbo man dey call 'autonomy'.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.

Image
Na di third time bi dis wey Governor Dapo Abiodun of Ogun state go add join di 'eased lockdown' for di state to make dem fit reduce as corona virus dey spread. Abiodun tok am on friday say di new days wey dem add join go start for May 25th na unto as pipo no gree hear word wey government bin dey yarn dem. Im tok say after dem don look di mata well, na im make dem take action say di 'eased lockdown' go still continue till Sunday, May 31st, 2020. Im took say, as dem dey try make everytin for balance, dem go open everywia make pipo for move from 7am go reach 5pm on Monday, 25th May, 2020; Wednesday, 27th May, 2020 plus join Friday, 29th May, 2020.

Man wey kill im cousin untop 2million naira for Edo

Image
Dem don find dead bodi of man wey dem tink say bin lost. Na Im brother kill am come bury am for Auchi. Usman Abdul Lateef, wey come from Akpekpe don dey miss since Wednesday (13th of May). Dey don find di dead bodi now say na Im cousin kill am, bury am for inside bush. We hear am say di man wey dem kill bin leave Im house on Wednesday wit Im cousin wey Im name bi Koma go Guarantee Trust Bank ATM to run transaction but e miss since den. As e happen, police arrest Koma as e bi say na Im bi di last persin wey e follow yarn before e miss. Police leave am after dem don touchlight di mata. As Azomode youth and police dey touchlight di mata for dem divisional headquarters, di family of di man wey die contact GTB for Auchi, and dem reason di Manager about wetin happen. As bank notice say persin dey try run show on di account, dem alert di family on Tuesday, May 19th as di persin still dey try withdraw moni. Na wetin con lead to as dem arrest Koma again and e con confess say na Im kill...