Man wey kill im cousin untop 2million naira for Edo
Dem don find dead bodi of man wey dem tink say bin lost. Na Im brother kill am come bury am for Auchi.
Usman Abdul Lateef, wey come from Akpekpe don dey miss since Wednesday (13th of May). Dey don find di dead bodi now say na Im cousin kill am, bury am for inside bush.
We hear am say di man wey dem kill bin leave Im house on Wednesday wit Im cousin wey Im name bi Koma go Guarantee Trust Bank ATM to run transaction but e miss since den.
As e happen, police arrest Koma as e bi say na Im bi di last persin wey e follow yarn before e miss. Police leave am after dem don touchlight di mata.
As Azomode youth and police dey touchlight di mata for dem divisional headquarters, di family of di man wey die contact GTB for Auchi, and dem reason di Manager about wetin happen.
As bank notice say persin dey try run show on di account, dem alert di family on Tuesday, May 19th as di persin still dey try withdraw moni.
Na wetin con lead to as dem arrest Koma again and e con confess say na Im kill am over 2million Naira land mata and e burry am inside bush for Igarra. Say im don plan to withdraw all di moni as Im get di ATM card and pin
Police wit Auchi vigilante squad don go carry di dead bodi for wia Koma bury am and dey don bury am properly according to muslim way as touchlighting of di mata dey continue.
Police wit Auchi vigilante squad don go carry di dead bodi for wia Koma bury am and dey don bury am properly according to muslim way as touchlighting of di mata dey continue.
Killer




Comments
Post a Comment