Posts

Showing posts from August, 2020

EL-RUFAI DON YARN SAY IM NOR GO CHANGE MOUTH O, SAY IM WAN MAKE PRESIDENCY GO TO SOUTH PIPO FOR 2023.

Image
Di Governor of Kaduna, Nasir El-Rufai don yarn on Sunday say im no go change mouth unto mata of 2023 presidency wey im tink say suppose enter south pipo of Naija hand. El-Rufai wey yarn wit Channels TV untop dia Sunday Politics show yarn say base on arrangement, afta President Muhammadu Buhari, presidency suppose shift go South. Im still yarn say, even Peoples Democratic Party, PDP, get dat kain arrangement to rotate power na why after Olusegun Obasanjo run Im own finish, Late Umaru Musa Yar'adua enta. Im yarn say nor bi say im go support north or south persin but di truth bi say, power need to shift go south for 2023 even though dat kain tin nor dey inside APC constitution. "After Buhari, wetin go makes sense for north politicians na to support candidate for south. I nor get believe for zoning but na my mind i jus yarn so. We bin don get arrangement like dis make we maintain am. "I no believe say any side for Naija get right say na dem must dey p...

Azubuike Ekwegbalu: Unknown men Dem don kill Gov. Obaino aid

Image
Hon Azubuike Ekwegbalu wet bi Senior Special assist (SSA) to governor of Anambra state, Governor Willie Obiano for untop security mata don die. Na so Igbere TV hear am. Na yesterday nite dem kill am. According di gist wey reach IgbereTV hand, Some men wey dem neva know kill Ekwegbalu for inside commissioner's quarters for Awka. Ekwegbalu bin come from Ogbunike for Oyi local government and im bi younger broda of do governor wife. Di way wet di mata take happen still get as e dey wen we dey write dis gist.

WOMAN PARA FINISH FOR MINNA UNTO SAY HER BOYFRIEND NOR TELL HER SAY IM DON MARRY WIT THREE PIKIN

Image
One woman for minna wey nor know say her boyfriend don marry don enta facebook dey threaten di man. She log in for di man facebook account con write RIP for di pishur of di man wey im name bi Chijioke and di pishur of im family too say dem don die. For wetin she yarn, she say, "I go kill all im family pipo and im go frustrate di way i frustrate so". She say she don abort for Chijioke two times and she nor know say di guy get wife and children for anoda place.

AJIMOBI ENTA HEAVEN- NA WETIN IM WIFE YARN BI DAT

Image
Florence, wey bi wife of late Oyo governor, Abiola Ajimobi, yarn say her husband dey for heaven. Di widow yarn did mata on Sunday for inside Oluyole, Ibadan. Florence yarn dis mata unto how Nigeria Union of Journalists (NUJ) leaders for Oyo state visit am. Di waka wey dia Chairman, Ademola Babalola lead go her house to greet her for Eid-el Kabir. Di before before First Lady say she miss everytin about her husband wey she yarn say bi her strength and number one supporter. She say Ajomobi live life wey dey fulfilled, say still yarn say, "Wetin man go gain of im reach 90 years and still nor reach heaven?" She say,  "Ajimobi enter heaven and di guy don settle wit God. Na my greatest consolation bi dat. Na my joy bi dat. I dey cry and feel bad becos I miss am." "Dis na becos if you dey di mind of pipo wey you love, e mean say, you live forever. Make God epp us, everytin wey im don achieve for Oyo state and Nigeria go live on fo...

DEM DON SHOOT ONE YOUNG MAN FOR OZORO, DELTA STATE UNTO SAY E DEY PROTEST.

Image
Di student community of Delta State Polytechnic, Ozoro don dey boil unto how dem don shoot one young man as dem bi dey do peaceful protest. Di unfortunate mata happen for on Monday morning wen youths wey dey carry cardboard and dem dey shout say "SOS go dey carry POS waka" as dem enta street for Ozoro to protest how police dey collect money for dia hand wit POS. Na so dem gun down dis young man and di whole area scatter.  As at di time wey dis report dey enta our hand, di dead bodi still dey floor and di whole area neva still settle.