DEM DON SHOOT ONE YOUNG MAN FOR OZORO, DELTA STATE UNTO SAY E DEY PROTEST.



Di student community of Delta State Polytechnic, Ozoro don dey boil unto how dem don shoot one young man as dem bi dey do peaceful protest.



Di unfortunate mata happen for on Monday morning wen youths wey dey carry cardboard and dem dey shout say "SOS go dey carry POS waka" as dem enta street for Ozoro to protest how police dey collect money for dia hand wit POS. Na so dem gun down dis young man and di whole area scatter. 



As at di time wey dis report dey enta our hand, di dead bodi still dey floor and di whole area neva still settle.


Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.