Posts

Showing posts from June, 2020

Graduates wey reach like 4,625 don apply for Amotekun Corps Job.

Image
Graduates wey reach like 4,625 for both Polytechnic and University don apply for Amotekun Corps job for Osun state.Dis number con bi like 35 percent of di overall number of pipo wey apply for di job. Na so PUNCH hear am. Twenty per cent of di pipo wey apply dey from University from various discplines and 15 perecent get Higher National Diploma. Application for Amotekun Corps job end for June 27 and pipo wey reach 13,000 apply for di job. Most of di pipo wey apply for di job na men wey don marry. Analysis still show say 1,891 female wey never marry sef join apply. According to details wey dey ground, men wey apply bi 9,214 amd 8,615 out of dem don marry. Di data still show say 4,002 females wey 2,011 of dem don marry sef apply for di work. Breakdown of dia education qualification still show say "10 percent of dem get Ordinary National Diploma, as five percent get National Certificate. Senior School Certificate holders dem bi 40 percent of di total pipo wey apply and six percent get...

COVID-19 test for Lagos na N50,400 only.

Image
Pipo wey dey live for Lagos wey nor fit see test do for government facility go fit run di test for private now if dem pay N50,400 on top COVID-19 Di health commissioner for di state, Professor Akin Abayomi don yarn di mata as e dey launch di Lagos State Private-Public Consortium on top COVID-19 management for to take increase how di government dey handle di COVID Im say even though di test dem dey come for free from lab wey bi government own, di private lab wey government go give go-ahead to go dey run am between N40,000 and N50,400. Wit wetin dey ground so, especially for those wey bi say dia body don get as e dey do dem wey relate to COVID and dem dey fear say government hospital nor go gree attend to dem quick, dis kain mata go good for dem. Di commissioner of Health for di state, Professor Abayomi yarn say di join bodi of private and government na to make how government dey respond to di COVID-19 mata make sense more.

FLORENCE AJIMOBI NOR FIT CLOSE HER SHOP FOR ONE DAY TO TAKE HONOR HER HUSBAND WEY DIE

Image
Binta Nasir tok from Lagos say, Ajimobi wife nor fit close her store for one day make she take honor her husband but she want make Governor of Oyo state, Makinde run come from travel.  E nor too good make Madam Florence Ajimobi dey play politics did kain time. After di burial of di Oyo state former Governor, Late Senator Isiaka Abiola Ajimobi, dem interview I'm wife. For di interview, she yarn say di governor of Oyo state nor care about her husband wen dem admit am for hospital and e nor even reason to visit dem wen di husband die. Afta Madam Florence don yarn her own, pipo con dey chuk mout for di mata online. One persin for twitter respond say Madame Florence wey nor fit close her shop< GRANDEX STORE for one day for to honor her husband wey die con dey expect make Makinde run come from wia im travel go. Many pipo see say her comment as say she dey us am dey do politics and she nor suppose dey use her husband death do dat kain tin.

Trending Twitter gist

Image
Last night, one Lady jus para dey para. Las las, she tell us why. .read di gist  Di accuser. Who she accuse

FG don yarn say make Daycare and Primary school never open at all

Image
Federal Government don yarn am say all di primary school for di whole Naija still dey closed. Make nobody try open dem. Na di National Coordinator of di Presidential Ast Force on Covid-19, Sani Aliyu, yarn dis mata on Monday from inside Abuja. "Make all daycare and primary school dey locked as dem dey so until government reason di mata well well" na so Im yarn di gist “All daycares and primary schools to remain closed till further evaluation,”  he said.

Boko Haram kill CJTF oga for Borno

Image
Di oga wey dey in charge of operations. For di CJTF for inside Doboa Local Government Area for Borno State, Arramma (Malaminya) don die. Im bin miss on Sunday afta Book Haram wahala tear enta Damboa as im bin dey escort some motor enter di town from Maiduguri. Na dia dem for kill am. Dem also kill ten army men join for di Book haram attack so.

BBNaija go start for July. Check when e go bi

Image
BBNaija season five wey una don dey wait for go soon finally start. Di show go start for July 19th so. Na on top BBNaija original twitter dem nak dis gist so. Unto di COVID-19 palava, di pipo wey dey arrange di show start to dey do online audition since May 29 dis year. . Di pipo wey dey audition bin send video of dem self for two minutes make dem use dia mouth yarn why dem wan enta BBNaija house for dis season. Na from dis same BBNaija show, na im star like Miracle, Bisola, CeeCee, Tacha and Mercy from show.

BURNA BOY WIN BET BEST INTERNATIONAL ACT FOR SECOND YEAR (FULL LIST OF WINNERS DEY INSIDE)

Image
Full list of winners from the 2020 BET Awards held today. Winners in each category is printed in bold fonts. ALBUM OF THE YEAR Lizzo — Cuz I Love You Megan Thee Stallion — Fever Beyoncé — Homecoming: The Live Album H.E.R. — I Used to Know Her DaBaby — Kirk Roddy Ricch — Please Excuse Me For Being Antisocial (WINNER!)  VIDEO OF THE YEAR Chris Brown featuring Drake – “No Guidance” DaBaby – “Bop” DJ Khaled featuring Nipsey Hussle & John Legend – “Higher” (WINNER!) Doja Cat – “Say So” Megan Thee Stallion featuring Nicki Minaj & Ty Dolla $ign– “Hot Girl Summer” Roddy Ricch – “The Box” COCA-COLA VIEWERS’ CHOICE AWARD Chris Brown featuring Drake – “No Guidance” DaBaby – “Bop” Future featuring Drake – “Life is Good” Megan Thee Stallion featuring Nicki Minaj & Ty Dolla $ign– “Hot Girl Summer” (WINNER!) Roddy Ricch – “The Box” The Weeknd – “Heartless” BEST COLLABORATION Chris Brown featuring Drake – “No Guidance” (WINNER!) DJ Khaled featuring Nipsey Hussle & John Legend – “Hi...

POLICE DON ARREST CULTIST FOR MEETING WEY DEM DEY DO FOR ABUJA

Image
Di police of FCT command don arrest ten suspect wey dey reason say bi cultist for Angwan Dadi, inside Nyanya. DSP Anjuguri Manzah, Public Relations Officer, yarn dis mata on Sunday. Im yarn say di suspect dem bi member of cult wey dem call demselves 'supreme Vikings confraternity' aka 'ro Bager' Dem nab dem on June 26 for around 11:30 for night wen dem dey do dia meeting. Di suspects bi: Samson, 21; Chisom Anakom, 25; Jonathan Ibinabo, 21; Oneh Chibueze, 25; Anyan Christian, 23; Moses Ogun, 23; Emmanuel Ugwu, 18; Monday Bitrus, 19; Yerima Micheal, 26 & Uwana Edet Okpo, 19. Two cutlasses, one long hammer, one pinches and one iron iron bar na im dem see collect from dia hand. Manzah yarn say dem go carry dem enta court after dem don touchlight di mata.

VICTOR OSIMEN DON WIN BEST AFRICAN PLAYER FOR LIGUE 1

Image
Lille striker, Victor Osimhen don win di 2020 Marc-Vivien Foe prize. Di Super Eagles forward win dis mata among oda players like Simon Moses wey dey Nantes, Denis Bouanga wey dey Saint-Etienne, Andy Delort wey dey Montpellier, Islam Slimani wey dey Monaco and Mbaye Niang, Hamari Traore and Edouard Mendy wey dey Rennes. Im club write am for twitter say "Victor Osimhen don win di Marc Vivien Foe prize wey b prize for best African player for French Ligue 1, for inside di French Footbal Championship for 2019/2020 season. Congratulations @victoromhen9!" Osimhen wey join Lille from Belgium first division club wey Im name be Sporting Charleroi as replacement for Cote d'ivoire star, Nicolas Pepe wey join Arsenal. Osimhen wey bi super Eagles star score 18 goals for 38 appearances for all competitions last season for Lille. Na im bi second winner after Vincent Enyeama win am for 2014.

Hushpuppi second, Mr Woodberry don sick afta 9 days for prison

Image
Hushpuppi second, Mr Woodberry don sick afta 9 days for prison Kemi Olunloyo don tweet di mata onto her tweeter as e dey hot for dat side.

Buhari go Inaugurate Ajaokuta-Kano Pipeline on Tuesday

Image
President Muhamadu Buhari don ready to inaugurate di construction of Ajaokuta-Kaduna-Kano has pipeline for Kogi State and for Rigachikun, Kaduna State. As di tweet wey Nigerian National Petroleum Corporation write yarn, Di ceremony go happen online on Tuesday. NNPC still tok say di construction work of di AKK pipeline go go togeda wit di inauguration wey di presido go do. Di gas pipeline project dey designed to facilitate di development of three gas-based independent power plant wey dey for Abuja, 1,350 megawatts; kaduna 900MW; and Kano, 1,350 MW. NNPC yarn say since e dey part of di Trans Nigeria Gas Pipeline, the AKK gas pipeline get capacity to transport  2.2billion standard cubic feet of gas everyday.

COCAVID Build Isolation centre with 150 bed

Image
Today, we don open 150-bed isolation centre for mainland infectious disease Hospital Yaba wey don increase how we go take reduce spread of #COVID19 We thank di private sector coalition against COVID-19(CACOVID) say dem provide dis correct facility. Lagos dey really try to win dis COVID-19 cos of our health workers dem wey dey do well, Private partnrs, NCDC, Federal Government and lagosians wey dey follow wetin we tok unto dis COVID mata. Make we nor stop to dey work togeda. We don ready to make sure say international infectious disease research centre dey dis hospital wen COVID finish. We go increase our infrastructure and we no go wait till sometin like COVID happen again before everytin go dey available. #COVID19 dey real and we dey owe everybody to dey careful and make dem follow instruction make we for fit defeat dis virus. Na why e dey very important to wear facemask for public, wash hand well-well or use sanitizer and to dey give each oda space. #StaySafe.

RIVERS GOVERNOR SAY IM PRAY MAKE DI KASALA WEY DEY APC CONTINUE

Image
Governor of Rivers state, Nyesom Wike don pray say make APC nor commot for inside di Kasala wey dem dey so. Wike yarn dis gist for one interview wit dem Arise TV. Im say shey we remember say dis same APC dey jubilate wen dem get kasala for PDP dat year wen di former Borno State Governor, Ali Modu Sheriff bi dia leader. I'm yarn say "I get joy as kasala dey inside APC, E nor concern me to helep dem dey ok. When we get our own too dat year, dem dey happy upandan. My prayer bi say make dem dey inside di kasala. We don collect anoda state from dia hand." "As di mata even bi, APC nor bi real political party, dey jus join bodi to take over power. I want make my party enta power so i nor go fit pray any beta prayer for APC. Make dem dey make mistake everyday make my own party for fit dey grow."

See wetin Senator Shehu Sanni tok about Restructuring

Image
Senator Shehu Sanni yarn dis mata pon im twitter handle. Judge di mata. How you sef see am.

DJ cuppy don join Man U and Man U welcome am officially.

Image
DJ cuppy wey bi one of di top DJs for Naija don switch from Arsenal go enta Man U She do di switch yesterday unto as Ighalo score and as she switch enta di club, Man U sef no slack o, den welcome her enta well well.

Ajimobi Burial: pipo dey fight unto food - Pictures and video

Image
IgbereTV capture moments wey crowd nor gree follow social distancing that is, to give each other space for di burial of di late Oyo state Governor, Abiola Ajimobi wey dem bury today. Pipo jus dey push each oda untop food mata. Pictures and videos dey ground. https://youtu.be/9g1HcYAPpUM

Obaseki go collect certificate for Abuja

Image
Governor of Edo state, Godwin Obaseki don go collect im certificate say na im go contest for governor under PDP for Edo state election. Dis mata happen today for inside PDP Secretariat for Abuja.

Peter Okoye and im family don test positive for coronavirus

Image
Peter Okoye, Im wife and dia domestic staff don test positive for CoronaVirus. See video https://youtu.be/Vc1nBFE3pB4 Make we open our eye and make we dey safe o.

Dem don release Ajimobi burial date - POLITICS

Image
Di Family of di former Governor of Oyo state wey die on Thursday, don finally release di date wey dem wan bury dia persin. Dem yarn dis mata on Friday evening from di mouth of di media aid of di former Governor, Bolaji Tunji, wey yarn di mata for im social media "As di burial of His Excellency, Senator Abiola Ajimobi go go, di family don release am". " As dem don consult di government of Lagos and Oyo state, dem don announce di burial date. "Dem go carry im bodi come senator Ishaq Abiola Ajimobi Central Mosque for Oke Ado, Ibadan for 12noon on Sunday wey bi 28th June, 2020 after dem don pray on am for Muslim way. "To really follow as government say make wey dey do for dis Covid-19 period, di family don beg pipo wey wan join for di burial make den follow Covid-19 protocol well well. "Dem go make pipo know how den go take show di burial for TV tomorrow." "For future wey no go too tey, wen pipo go fit gather well, we go still run anoda funeral wey p...

Accident happen for Agric Bus stop - INSIDE LIFE

Image
Gbege bin wan shele as container wit full load tear enta Agric BRT bus stop. Dem say if no bi say di driver quickly get sense to swerve, tins for spoil.. Thank God say tins nor too spoil and pipo nor die. Tragedy was averted as a fully loaded container lost control and crashed into the popular Agric BRT terminal. Many praised the driver for swiftly making a decision that prevented a major tragedy. Pictures below.

Dem don remove all Oshiomole picture commot for APC secretariat - POLITICS

Image
As dem don scatter di National Working Committee, NWC of All Progressives Congress, APC, dem don remove all di poster and picture of di Chairman wey dem suspend, Adams Oshiomole from di National Secretariat. Politics Naija hear di gist say e nor reach 24 hours wey dem suspend di former chairman wey dem remove all di picture and poster. Dem remove Oshiomole picture from two big signborad wey dey di entrance of dia headquarter and di one wey dey inside for Abuja. Na only President Muhamadu Buhari own con remain. We hear am say e never tey after dem scatter NWC, staff wey dey di headquaters jus begin dey dance upandan as dem dey tear Oshiomole picture anywia dem see am for the headquarter. Oshiomole wahala bin really expand wen Im and Edo state Governor, Godwin Obaseki start quanta. Na dis dia wahala so cause a wey make Obaseki no qualify for APC primary for Edo before di guy con port enta PDP. Di gist nor too sweet plenti pipo for APC for belle. E nor they afta dia two kasala wey court o...

CHRIS HEMSWORTH, NETFLIX DON PRAISE IKORODU BOIS AS DEM REMAKE EXTRACTION TRAILER, DEM DON EVEN INVITE DEM TO DI PREMIERE

Image
Di Ikorodu bois wey dey shaprapra for internet wit dia remake of  videos wey oda pipo don do don jam beta luck now as dem don land invitation to di world premiere of Netflix action thriller, Extraction, after dem remake di first trailer. Di ikorodu bois bin create and share di remake for dia Twitter page. " We so much love dis movies and we hope say @chrishemsworth and @Netflix see di remake wey we do so, abeg make una retweet" na so dey write for di video wey show di shot-by-shot version of di trailer . Di producers of Extraction, Anthony Russo and Joseph Russo, wey dem dey call, Russo brothers don hail dem on di remake and still con invite dem com watch di film wen e premere for abroad. "Dis one make sense! We go like make una show for di #Extraction 2 premiere... DM us and we go carry una reach dia!" Chris Hemsworth, wey bi star for di film post di remake for Im Instagram. "big shout out to dem beta young film makers @ikorodu_bois as dem recreate @extraction...