COVID-19 test for Lagos na N50,400 only.
Pipo wey dey live for Lagos wey nor fit see test do for government facility go fit run di test for private now if dem pay N50,400 on top COVID-19
Di health commissioner for di state, Professor Akin Abayomi don yarn di mata as e dey launch di Lagos State Private-Public Consortium on top COVID-19 management for to take increase how di government dey handle di COVID
Im say even though di test dem dey come for free from lab wey bi government own, di private lab wey government go give go-ahead to go dey run am between N40,000 and N50,400.
Wit wetin dey ground so, especially for those wey bi say dia body don get as e dey do dem wey relate to COVID and dem dey fear say government hospital nor go gree attend to dem quick, dis kain mata go good for dem.

Di commissioner of Health for di state, Professor Abayomi yarn say di join bodi of private and government na to make how government dey respond to di COVID-19 mata make sense more.
Comments
Post a Comment