CHRIS HEMSWORTH, NETFLIX DON PRAISE IKORODU BOIS AS DEM REMAKE EXTRACTION TRAILER, DEM DON EVEN INVITE DEM TO DI PREMIERE
Di Ikorodu bois wey dey shaprapra for internet wit dia remake of videos wey oda pipo don do don jam beta luck now as dem don land invitation to di world premiere of Netflix action thriller, Extraction, after dem remake di first trailer.
Di ikorodu bois bin create and share di remake for dia Twitter page.
"We so much love dis movies and we hope say @chrishemsworth and @Netflix see di remake wey we do so, abeg make una retweet" na so dey write for di video wey show di shot-by-shot version of di trailer.
Di producers of Extraction, Anthony Russo and Joseph Russo, wey dem dey call, Russo brothers don hail dem on di remake and still con invite dem com watch di film wen e premere for abroad.
Di producers of Extraction, Anthony Russo and Joseph Russo, wey dem dey call, Russo brothers don hail dem on di remake and still con invite dem com watch di film wen e premere for abroad.
"Dis one make sense! We go like make una show for di #Extraction 2 premiere... DM us and we go carry una reach dia!"
Chris Hemsworth, wey bi star for di film post di remake for Im Instagram.
"big shout out to dem beta young film makers @ikorodu_bois as dem recreate @extraction trailer shot-by-shot! Bi like say una own even beta pass di original!! @netflixfilm" na so Im write.
Even di director of Extraction sef share di video and I'm write say:
"Dis one make am o! Dem young filmmakers from Naija remake #Extraction trailer shot-for-shot. E too make sense. If you wan watch am, check my bio."

Di Ikorodu Bois don popular as dem dey copy videos and films. For April, Spain Actor Alvaro Morte, wey bi lead character for Money Heist, hail dem. Di bois don also receive hailings from oda major Hollywood actors like, Will Smith and Dwayne "The Rock" Johnson.

Comments
Post a Comment