Dem don release Ajimobi burial date - POLITICS
Di Family of di former Governor of Oyo state wey die on Thursday, don finally release di date wey dem wan bury dia persin.
Dem yarn dis mata on Friday evening from di mouth of di media aid of di former Governor, Bolaji Tunji, wey yarn di mata for im social media "As di burial of His Excellency, Senator Abiola Ajimobi go go, di family don release am".
" As dem don consult di government of Lagos and Oyo state, dem don announce di burial date.
"Dem go carry im bodi come senator Ishaq Abiola Ajimobi Central Mosque for Oke Ado, Ibadan for 12noon on Sunday wey bi 28th June, 2020 after dem don pray on am for Muslim way.
"To really follow as government say make wey dey do for dis Covid-19 period, di family don beg pipo wey wan join for di burial make den follow Covid-19 protocol well well.
"Dem go make pipo know how den go take show di burial for TV tomorrow."

"For future wey no go too tey, wen pipo go fit gather well, we go still run anoda funeral wey plenti of pipo wey like am go fit join di level.
“
“

Comments
Post a Comment