RIVERS GOVERNOR SAY IM PRAY MAKE DI KASALA WEY DEY APC CONTINUE
Governor of Rivers state, Nyesom Wike don pray say make APC nor commot for inside di Kasala wey dem dey so.
Wike yarn dis gist for one interview wit dem Arise TV. Im say shey we remember say dis same APC dey jubilate wen dem get kasala for PDP dat year wen di former Borno State Governor, Ali Modu Sheriff bi dia leader.
I'm yarn say "I get joy as kasala dey inside APC, E nor concern me to helep dem dey ok. When we get our own too dat year, dem dey happy upandan. My prayer bi say make dem dey inside di kasala. We don collect anoda state from dia hand."
"As di mata even bi, APC nor bi real political party, dey jus join bodi to take over power. I want make my party enta power so i nor go fit pray any beta prayer for APC. Make dem dey make mistake everyday make my own party for fit dey grow."

Comments
Post a Comment