Buhari go Inaugurate Ajaokuta-Kano Pipeline on Tuesday

President Muhamadu Buhari don ready to inaugurate di construction of Ajaokuta-Kaduna-Kano has pipeline for Kogi State and for Rigachikun, Kaduna State.




As di tweet wey Nigerian National Petroleum Corporation write yarn, Di ceremony go happen online on Tuesday. NNPC still tok say di construction work of di AKK pipeline go go togeda wit di inauguration wey di presido go do.


Di gas pipeline project dey designed to facilitate di development of three gas-based independent power plant wey dey for Abuja, 1,350 megawatts; kaduna 900MW; and Kano, 1,350 MW.

NNPC yarn say since e dey part of di Trans Nigeria Gas Pipeline, the AKK gas pipeline get capacity to transport  2.2billion standard cubic feet of gas everyday.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.