Dem don remove all Oshiomole picture commot for APC secretariat - POLITICS


As dem don scatter di National Working Committee, NWC of All Progressives Congress, APC, dem don remove all di poster and picture of di Chairman wey dem suspend, Adams Oshiomole from di National Secretariat.




Politics Naija hear di gist say e nor reach 24 hours wey dem suspend di former chairman wey dem remove all di picture and poster. Dem remove Oshiomole picture from two big signborad wey dey di entrance of dia headquarter and di one wey dey inside for Abuja. Na only President Muhamadu Buhari own con remain.

We hear am say e never tey after dem scatter NWC, staff wey dey di headquaters jus begin dey dance upandan as dem dey tear Oshiomole picture anywia dem see am for the headquarter.


Oshiomole wahala bin really expand wen Im and Edo state Governor, Godwin Obaseki start quanta. Na dis dia wahala so cause a wey make Obaseki no qualify for APC primary for Edo before di guy con port enta PDP. Di gist nor too sweet plenti pipo for APC for belle.


E nor they afta dia two kasala wey court of appeal say Oshiomole suspension legit for National Executive Committee meeting on Thursday wey scatter di National Working Committee wey Oshiomole bin dey head.


Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.