COCAVID Build Isolation centre with 150 bed
Today, we don open 150-bed isolation centre for mainland infectious disease Hospital Yaba wey don increase how we go take reduce spread of #COVID19
We thank di private sector coalition against COVID-19(CACOVID) say dem provide dis correct facility.
Lagos dey really try to win dis COVID-19 cos of our health workers dem wey dey do well, Private partnrs, NCDC, Federal Government and lagosians wey dey follow wetin we tok unto dis COVID mata.
Make we nor stop to dey work togeda.
We don ready to make sure say international infectious disease research centre dey dis hospital wen COVID finish. We go increase our infrastructure and we no go wait till sometin like COVID happen again before everytin go dey available.

#COVID19 dey real and we dey owe everybody to dey careful and make dem follow instruction make we for fit defeat dis virus.
Na why e dey very important to wear facemask for public, wash hand well-well or use sanitizer and to dey give each oda space.
#StaySafe.

Comments
Post a Comment