FLORENCE AJIMOBI NOR FIT CLOSE HER SHOP FOR ONE DAY TO TAKE HONOR HER HUSBAND WEY DIE
Binta Nasir tok from Lagos say,
Ajimobi wife nor fit close her store for one day make she take honor her husband but she want make Governor of Oyo state, Makinde run come from travel.
E nor too good make Madam Florence Ajimobi dey play politics did kain time. After di burial of di Oyo state former Governor, Late Senator Isiaka Abiola Ajimobi, dem interview I'm wife. For di interview, she yarn say di governor of Oyo state nor care about her husband wen dem admit am for hospital and e nor even reason to visit dem wen di husband die.
Afta Madam Florence don yarn her own, pipo con dey chuk mout for di mata online. One persin for twitter respond say Madame Florence wey nor fit close her shop< GRANDEX STORE for one day for to honor her husband wey die con dey expect make Makinde run come from wia im travel go.
Many pipo see say her comment as say she dey us am dey do politics and she nor suppose dey use her husband death do dat kain tin.
Many pipo see say her comment as say she dey us am dey do politics and she nor suppose dey use her husband death do dat kain tin.
Comments
Post a Comment