POLICE DON ARREST CULTIST FOR MEETING WEY DEM DEY DO FOR ABUJA


Di police of FCT command don arrest ten suspect wey dey reason say bi cultist for Angwan Dadi, inside Nyanya.




DSP Anjuguri Manzah, Public Relations Officer, yarn dis mata on Sunday.

Im yarn say di suspect dem bi member of cult wey dem call demselves 'supreme Vikings confraternity' aka 'ro Bager'


Dem nab dem on June 26 for around 11:30 for night wen dem dey do dia meeting.


Di suspects bi:
Samson, 21;
Chisom Anakom, 25;
Jonathan Ibinabo, 21;
Oneh Chibueze, 25;
Anyan Christian, 23;
Moses Ogun, 23;
Emmanuel Ugwu, 18;
Monday Bitrus, 19;
Yerima Micheal, 26 &
Uwana Edet Okpo, 19.


Two cutlasses, one long hammer, one pinches and one iron iron bar na im dem see collect from dia hand.


Manzah yarn say dem go carry dem enta court after dem don touchlight di mata.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.