AJIMOBI ENTA HEAVEN- NA WETIN IM WIFE YARN BI DAT


Florence, wey bi wife of late Oyo governor, Abiola Ajimobi, yarn say her husband dey for heaven.



Di widow yarn did mata on Sunday for inside Oluyole, Ibadan.

Florence yarn dis mata unto how Nigeria Union of Journalists (NUJ) leaders for Oyo state visit am.

Di waka wey dia Chairman, Ademola Babalola lead go her house to greet her for Eid-el Kabir.

Di before before First Lady say she miss everytin about her husband wey she yarn say bi her strength and number one supporter.

She say Ajomobi live life wey dey fulfilled, say still yarn say, "Wetin man go gain of im reach 90 years and still nor reach heaven?"

She say, "Ajimobi enter heaven and di guy don settle wit God. Na my greatest consolation bi dat. Na my joy bi dat. I dey cry and feel bad becos I miss am."

"Dis na becos if you dey di mind of pipo wey you love, e mean say, you live forever. Make God epp us, everytin wey im don achieve for Oyo state and Nigeria go live on forever" She yarn.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.