EL-RUFAI DON YARN SAY IM NOR GO CHANGE MOUTH O, SAY IM WAN MAKE PRESIDENCY GO TO SOUTH PIPO FOR 2023.


Di Governor of Kaduna, Nasir El-Rufai don yarn on Sunday say im no go change mouth unto mata of 2023 presidency wey im tink say suppose enter south pipo of Naija hand.



El-Rufai wey yarn wit Channels TV untop dia Sunday Politics show yarn say base on arrangement, afta President Muhammadu Buhari, presidency suppose shift go South.

Im still yarn say, even Peoples Democratic Party, PDP, get dat kain arrangement to rotate power na why after Olusegun Obasanjo run Im own finish, Late Umaru Musa Yar'adua enta.

Im yarn say nor bi say im go support north or south persin but di truth bi say, power need to shift go south for 2023 even though dat kain tin nor dey inside APC constitution.

"After Buhari, wetin go makes sense for north politicians na to support candidate for south. I nor get believe for zoning but na my mind i jus yarn so. We bin don get arrangement like dis make we maintain am.

"I no believe say any side for Naija get right say na dem must dey power. for 1998, dis country join bodi say make poer enta southwest."

"E go make sense say for 2023, make all party dem present person for south as dia candidate."

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.