Lagos State wan spread land ontop water.




Make dem for fit increase di available house and infrastructure for di state, di Lagos State Government don yarn say dem go build more man-made island near all I'm water for inside di whole Lagos state

Di Honourable Commissioner for Waterfront Insfrastructure Develipment, Arch. Ahmed Kabiru Abdullahi, don yarn today for di 2020 Ministerial Press Briefing for JJT Park wey dey Alausa, Ikeja, to mark as e don complete one year wey Governor Babajide Sanwoolu start I'm government.

Di commissioner tok say work don begin to take collect bacjk 100 hectares of land wey dem propose for mixed-use development wey dem call '' Osita Islands'', wey dey beside Orange Island for Eti-Osa Local Government Area so.

Abdullahi still yarn say approval don dey to collect back 54.58 hectares for Makoko for redevelopment, as Majidun-Awori Island project go start make dem use am bring commercial and residential real estate development mata come Ikorodu side

As I'm dey yarn say di works dem na both Public-Private partnership e go take work, Abdullahi don list other project wey go still show soon, like, King's city Island, wey dem go put ontop 150 hectares and go dey located 300 metres north of Victoria Garden City; plus join Olumegbon Royal Land (Palaver Yard Extension) wey reach 6.6 hectares of land

Im still tok say di Lagos State Government don continue to dey work wit dem partners for inside Orange and Gracefield Islands wey work dey go for dia so.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.