Fire don burst Olaleye market for Shomolu inaide Lagos



Pipo wey dey live for shomolu for Lagos no fit sleep last night o, as fire wey burst Olaleye market no gree dem.

Punch hear am say na for 3am di fire start, e burn market wey go reach billions of naira.

Till now, dem never still know wetin cause am. No body die for di mata.

Officers of Lagos State Emergency Management Agency and di Federal Fire service don reach di place so.

Persin wey dey yarn for LASEMA tok say, "As dem reach, dem see say Olaleye market don burst wit fire"

"As e dey so, we still dey touch light di mata to know how di fire start".







" Market wey reach billions of naira don kpafuka so but nobodi die for di mata"







Na punchonline.com did mata from come




Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.