POLICE DON SEIZE MAGU BULLETPROOF MOTOR DEM

Police wey dem join wit Criminal Investigation Department don seize two official bulletproof motor of Acting Chairman of Economic and Financial Crimes Commission, Ibrahim Magu wey dem suspend.



SaharaReporters gist di mata say dem collect one of di motor for Abuja and di oda one na Maiduguri for Borno State dem collect am.

Dem bin carry di motor dem go Police Headquaters and dem later carry dem go EFCC headquarters.

SaharaReporters hear am say some of di police dem burst enta EFCC office, seal Magu office wey dey 10th floor for di new EFCC building wey dey along Airport Road, Jabi, Wuse II.

Dem no allow any staff enter di 10th floor wia Magu office dey.

Magu dey face serious question from panel wey dey Presidential villa unto say im misuse moni wey dey dem collect from pipo wey steal and as im no dey truthful unto assets wey dem recover too.

Dem still say im mis spend N700m wey suppose bi for EFCC staff training.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.