ONE GROUP FOR NORTH DON ADVICE BUHARI MAKE E CANCEL NDDC AND NEDC
Dem don advise Muhamadu Buhari government make dem cancel Niger Delta Development Commission and North East Development Commission as dem jus dey take advantage of di masses.
Isah Abubakar, di National President of Northern Youth Council of Nigeria and Chairman of Nigeria Citizen Action Group yarn am for one gist wey commot on Monday for Kaduna say, "We advise make Presido Buhari sharpaly cancel di two commission cos dem dey take advantage of di masses".
Im still advise say make di government make di government join dem togeda make dem for take reduce cost and corruption.
Di statement still suggest am say make di Minister of Niger Delta, Godswill Akpabio resign by imself make dem for fit investigate di mata of di ministry and commission wella.
From di mata wey dey ground, we go see am say di two commission no dey do anytin to develop anywia, wetin dey dia mind na how to steal money wey suppose bi for development of di region.
"With di audit wey dem dey audit Niger Delta Development Commission so, if dem say make anoda committee investigate North East Development Commission, difference nor go too dey. We nor go need dis two agencies if government dey do dia work well".
"Nor bi lie say from 2000 till today, money wey dem don steal for NDDC alone don pass 20 Trillion Naira, dis kain big money fit change a whole country, not to tok of region. Only 1.1% of di pipo wey dey dat region don benefit from dis corrupt government.

Comments
Post a Comment