BI like say Runtown don dey date Australian fashion model, Adut Akech Bior.
Runtown wey bi Nigerian Singer and Im don bi 30 years old and South Sudanese-Australian fashion model Adut Akech Bior, wey bi 20 years old bi like say dem don dey
date each oda.
Two of dem carry leg enta dia Instagram account dey share love video wia dem dey enjoy dem self as Runtown wey don born one pikin before dey kiss di model for sweet way.
Akech, wey start her fashion week runway exclusive show for Saint Laurent S/S 17 show don work work wit oda big company like Chanel, Valentino and Givenchy join plenty odas
Runtown bin don dey wit model wey dey US, Selena Leath wey born im pikin, Zamar for am



Comments
Post a Comment