POLICE RESCUE SOLDIERS WEY BOKO HARAM BI DON CAPTURE


Di Nigeria Police Counter-terrorism operative dem don rescue two soldiers wey Boko Haram bin carry for Borno State.



PRNigeria hear gist say di terrorist bin don kill some security pipo and carry some go afta dem attacksoldiers wey dey patrol.

Dis mata happen afta Nigeria soldiers bin weak attempt of di terrorist as dem bi wan hijack army barrack for M
aiduguri on Monday.

As  one report comot wey  PRNigeria see, di gist bi say "For 2:30pm on July 13, 2020, Boko Haram attack army patrol for Auno Road and dem kill two soldiers and kidnap oda ones as dem carry military gun truck, Ak 47 rifles and oda ammunition wey plenty wel well.

"Counter Terrorism Unit of Nigerian Police for one operation wey dem call pin down point follow di terrorists and after dem do fight wit gun, dem see one gun truck collect back, rifles and dem still rescue two soldiers alive.

All di tins wey dem collect don reach Commissioner of Police hand"

For anoda gist, Nigerian troops don spoil terrorist plan as dem bi wan hijack army barrack for Maiduguri.


PRNigeria hear am say na 333 Artillery Barracks of Nigerian Army dem bi wan hijack but after dem don do fire for fire for more dan two hours for Monday night go reach Tuesday morning, di terrorists nor see change take hijack di barrack.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.