PRINCESS SHYNGLE SAY SHE DEY PROUD SAY SHE DEY DO BOTH MAN AND WOMAN (SAY SHE BE BI-SEXUAL)
Ghanaian Actress wey come from Gambia, Princess Shyngle don yarn say she dey proud say she bi Bisexual dat is, she fit nack both man and woman.
For one video wey show for social media, d actress wey her mata nor too strait, dey tok am inside di video say she like boys and girls and she nor shame untop di mata
Dis nor bi di first wey she don link herself wit dis kain tin.
For one pishur wey she snap wit Toyin Lawani for 2019 wia di two of dem pose like say dem wan do, pipo for social media bin accuse dem say di two of dem dey run lesbianism package. Dem no deny am say na lie.



Comments
Post a Comment