Trump Administration don start to formally withraw from World Health Organiation.
As CNN Gist am, Trump Administration don notify Congress and di United Nations say United States go formally withdraw from World Health Organization, many officials don yarn say di mata enta as corona virus number dey rise for America for last week alone.
Sen. Robert Menendez, wey bi top Democrat for di senate Foreign Relations Committee tweet am on Tuesday.
"Congress receive di notification say POTUS (President Of The United States) don officially withdraw U.S from WHO even as did corona virus pandemic still dey. As Trump dey handle dis COVID matter nor too make sense. Dis way nor protect lives of American pipo. E go jus make American pipo sick and wit no epp" Na wetin im tok bi dat.
One State Department official don confam am say "America don submit dia notice of withdrawal, wey go take effect from July 6, 2021, give di UN Secretary-General, wey dey collect information for WHO."
Di letter wey dem address give UN dey very short, like three sentences, na so confam aproko gist CNN and dem go make dem withdraw for one year but di person no fit confirm if im see di final version of di leta wey dem send.
As lawmakers from di two party wey dey di country bin don yarn am say dem get systemic problems with WHO, but dem nor support as di president wan withdraw for did kain time wey di whole world dey face coronavirus.
Even as dem tok say World Health Organization "help" China government cover up how coronavirus take start, members of GOP China task force don say make President Trump think dis mata again cos U.S fit make big difference for di International bodi.

Comments
Post a Comment