FG DON APPROVE BAILOUT FOR BROADCAST STATION
Buhari Administration don announce say dem go epp wit 60% cancellation of debt and 40% discount for licensing fee for all broadcast stations wey dey Naija from July 10, 2020.
Dis mata na part of di move to make sure say broadcast industry dey financially stable as COvid-19 dey affect so.
All broadcast station wey dey function dey entitled to di debt cancellation so far dem pay di 40% of dia license moni within three months.
All broadcast station wey dey function dey entitled to di debt cancellation so far dem pay di 40% of dia license moni within three months.
Minister wey dey handle Information and Culture, lai Mohammed wey announce am yarn say Money wey broadcast stations dey owe Federal Government don enter N7.8 billion.
Dis bailout not concern TV stations wey dem dey pay to watch o.

Comments
Post a Comment