NOR BI ME DEY CONTROL BUHARI O: MAMMAN DAURA
Na im bi di head of kitchen cabinet for President Muhammadu Buhari administration and im bi nephew of di president. Malam Mamman Daura yarn say im no believe say make we dey rotate who go lead Naija suppose come from North or south, say na persin wey qualify pass suppose determine who go bi Presido for 2023.
"We don do dis turn-by-turn government three times and di tin no pay...E beta for dis country make we bi one. Di position suppose bi for who sabi pass nor bi where persin from" Na so im gist BBC Hausa for di interview.
Im still tok about im relationship wit im uncle say, no bi as everybody believe say na im dey tell Presido wetin to do, no bi so di mata bi.
"No bi lie say i dey go greet am, I dey advise am too, when im ask me. No bi say i go jus decide by myself make i go dia go dey advise am. No! dem no dey do dat kain tin for government" na so di Daura tok.

Comments
Post a Comment