TRAILER LOSE CONTROL GO CRUSH BUS FOR APAPA-OSHODI EXPRESS WAY
TRAILER LOSE CONTROL GO CRUSH BUS FOR APAPA-OSHODI EXPRESS WAY
E no less pass two pipo wey loss dia life yesterday evening for Apapa-Oshodi expressway (directly under waka waka bridge for Ilasamaja, Mushin, Lagos State), as driver lose control of im trailer before di trailer con fall ontop danfo wey park beside am. Passengers don almost full inside di danfo.
Pipo wey dey pass quickly carry pipo wey wound and di ones wey faint comot from di bus but as at di time wey we dey write dis report, two of di passengers don die as dem jus put dem for road.
Person wey im eye reach ground on di mata say di driver of di trailer run as im see wetin im don do. “E still surprise us say nothing do two of di passengers wey we rescue”
Person wey im eye reach ground on di mata say di driver of di trailer run as im see wetin im don do. “E still surprise us say nothing do two of di passengers wey we rescue”
Even tho dis pictures no good at all, make una helep us identify and contact family of di pipo wey don die if una know dem.
We go dey update una as di mata dey go.
Comments
Post a Comment