Dem don Jail Reverend wey Rape 16-year old house maid for Kaduna



One Reverend, Joseph Ma'aji wey dey Barnawa, Kaduna, wey dem accuse say im rape 16-year-old house girl don enta remand for National Security and Civil Defence Corps (NSCDC) hand on Tuesday. Na Chief Magistrate Court for Kaduna run di mata. 




Di Chief Magistrate, Bashir Shittu, order say make dem remand Ma'aji until dey receive advise from office of director of Public Prosecution.


Di Magistrate tok say di court nor get power to judge di mata of di persin wey dem accuse for di rape mata.


"Even though di law say make dem carry dat kain persin go court wey near am. na why we bring di mata come her until police conclude dia investigation and dem send di case file go ministry of justice.


"Di lawyers for di ministry of justice go go through di fact wey dey inside di case file , if dey find sufficient evidence, dem go charge am go high court.


"We go also transfer you go High Court make trial for start. If we no find any evidence, we go discharge you and di case go stop" Na so di Magistrate tok.

Dem don shift di case enta Aug. 25 beforedem chuk mouth enta again.

NSCDC legal officer wey dey ontop di mata, Yayayi Jauro, don tok say on July 1, di state social welfare office in Kakuri, Kaduna, na im report di case of sexual harassment plus join indecency agaonst di Reverend.


Jauro yarn say dem don report Ma'aji many times say im dey sex di under age house girl wey di girl uncle say make im dey wit di Reverend. Di girl don dey di Reverend house for Kaduna since 2015.


Jauro add am say Ma'aji don dey molest di girl and still dey request sex from di girl. Im don even confess say true-true, im do am.


"Medical pipo don report from Gwamna Awan hodpital say di mata na true.

"im say di offence get punishment under section 257, 260 and 262 of di Kaduna State penal code law of 2017

He said the offence contravened section 257, 260 and 262 of the Kaduna State penal code law of 2017.


News Agency of Nigeria (NAN) don report say non Governmental Organization wey bi, Bridge di Gap Initiative don report di mata to state Ministry for Human Services and Social Development, request make dem monitor di case closely.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.