Defence Headquaters don nab some Boko Haram Terrorists
Di Defence Headquaters (DHQ) on Sunday don yarn say four terrorists, wey two women dey inside, Aishatu Manye and Kelune Mate, wey dem don identify say dem bi wife of local Boko Haram commander for Gajingi for Madagali area inside Adamawa State dey part of terrorists wey dem capture alive for di 17 operations wey military do last month as dem dey try to end activities of terrorists for we country.
Dis mata dey inside statement wey dem yarn give news pipo for Abuja from di Coordinator of Defence Media operations (DMO) Major John Enenche.
Im yarn say for dis same mata, dem don kill 75 members of di group wen dem meet dem 17 times for June as soldiers bombard dem wey make many of dem surrender for di month.
Gen Eneche still con tok say di troops arrest one Boko Haram spy wey im name bi Kawalu for inside Michika as dem capture anoda Boko Haram fighter for Miyanti area for Bama inside Borno.
Im yarn say di attack lead to how dem recover plenty arms and ammunition, wey one anti-aircraft gun, 13 AK-47 rifles, one sniper rifle, 21 local guns, two Dane guns plus join one rocket-propelled gun dey inside.
im still tok say, "Di three pipo wey dia names bi Mohammed Babagana, Modu Jugudun and Alhaji Usman surrender to troops of Delta Company for Strong Response Area, Pulka inside Gwoza, as one Mustapha Kori sef surrender give Army Super Camo 11 Gamboru, Ngala for Borno

"E go still make sense make una know say for dis period wey we dey tok so, army pipo ewscue 35 pipo from hand of BHTs/ISWAP criminals dem. Dem rescue 18 women, 16 children and one man.
“We quickly give polio vaccine to di children as e bi wit di Buratai Intervention Initiative as we give First Aid to di women as dem take need am"
Im say, Chief of Army Staff, Lt.-Gen. Tukur Buratai, don thank di Army pipo dem for how dem dey work wit dia whole mind and unto as dem dey show dia love for we country to finish any Boko Haram member wey still dey.

Comments
Post a Comment