GOVERNOR YAHAYA BELLO DEY DIRECT TRAFFIC FOR KOGI




Governor of Kogi State, Yahaya Bello enta road on Sunday evening wit officers of Federal Road Safety Corps (FRSC) dem and oda security agency, dey control traffic for Abuja-Lokoja road wey bin don block for over two days.

Di governor reach Jamata area for di state wit some of im security and aide. Dem dey dia for more dan five hours dey direct traffic wey don hold passenger dem since Friday night for one place.

We hear am say Governor Bello reach dia around 6:30pm for evening as im call oda security agencies dem make dem send dia pipo come di place to make all of dem join hand make di road for clear.

As im dey follow news pipo yarn, Governor Bello say na unto di gist wey dem gist am about how di traffic bi for di road for Kpata go reach Koto/Kotonkarfe local government, na im make am take action.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.