DEM SEE ALBINO TORTOISE FOR INDIA
One farmer for eastern India don see yellow tortoise wey sabi pipo (experts) say na product of albino level.
Basudev Mahapatra see di tortoise as im Sujanpur village, for Odisha, inside Balasore district, and im decide make im carry am come house as forest worker, Susanta Nanda gist CNN on Tuesday.
Mahapatra find di tortoise on Sunday and im give forest workers dem before dose ones call di pipo wey dey take care of animals.
Siddhartha Pati, wey bi executive director for di association for Biodiversity Conservation wey dey work to make sure say wild animals and dia environment dey protected, tell CNN say na di first time wey im go see dis kain tortoise.
Pati explain say di color na cos di tortoise get albino gene for bodi. "na disorder wey oyinbo dey call congenital disorder, wen wetin dem dey call tyrosine pigment nor reach or nor dey at all"
" get sometimes wey mutation fit happen for di gene when di tyrosine nor reach" Dem don release di tortoise enter forest again for Balasore.
Di name of the tortoise na Indian flapshell turtle. This one wey dem see na adult - wey go don reach like one and half or two years old.
"We dey see tortoise and crabs well well and we dey save dem, put dem back for inside water. But na di first time for Odisha and second time for India wey we go find tortoise wey bi albino".
Did kain tortoise common for Pakistan, Sri Lanka, India, Nepal, Bangladesh and Myanmar. Food wey e dey chop na frog, snail, and grass wey dey unto ocean.
For 2016, dem see one gree albino tortoise wey jus hatch for Australia beach. Volunteers from Cooum and North Shore Coast Care dey surprise to see di small tortoise. Dem name am small Alby, for Castaways Beach, for Sunshine Coast wey dey inside Queensland.
For 2016, dem see one gree albino tortoise wey jus hatch for Australia beach. Volunteers from Cooum and North Shore Coast Care dey surprise to see di small tortoise. Dem name am small Alby, for Castaways Beach, for Sunshine Coast wey dey inside Queensland.

Comments
Post a Comment