WIFE OF PETER OKOYE (P-SQUARE) TNK PIPO AS DEM DEY SUPPORT DEM FOR DIS TIME WEY DEM GET COVID-19 SO
Wife of Singer Peter Okoye wey her name bi Lola Omotayo-Okoye don tank everybody wey contact her and her family wen dem bin gather get COVID-19.
Una go remember say Peter, wey bi part half part of di before before group of P-square gist am sam I'm family bin don get Corona.
Peter wey bi 38years say all of dem, Im, wife and children plus join dia cook and two pipo wey dey work for dem for house don catch di virus.
Lola don come out to say, Nagode to all di pipo wey support dem for di period wey dem take get di disease, say di tin no bi here o, say she dey in pains during fi period and she nor go even wish make her enemy get di virus
Na wetin she gist for Instagram b dis:
Na wetin she gist for Instagram b dis:
"I wan tank my Doctor, Dr Ayo, who take beta care of me, my family and staff, I wan tank pipo wey reach out to us for dis teribble Covid-19 wey we experience.
My dear friends and amily, I thank una for di love. Una calls and prayers helep my family heal fast fast. God grace dey untop my family head and I dey very grateful to Almighty God. My love and prayer bi say di pipo wey still dey battle dis tin, God go heal una, una nor dey alone for di mata, we dey pray for una.
For una wey lose pipo wey close to una for dis period, I dey pray pray for una wella, e dey pain me enta bone say una lose persin. we need make we keep our parents safe. Make una encourage old pipo make dem stay for house o. Make una store vitamins for una house o. Vitamin C, Vitamin D, Vitamin B, Zinc! Covid-19 nor bi joke o. Di healing dey slow but hopefully, I go dey 100% Ok soon. We need to win dis tin togeda. I love all of una and I dey very grateful to God say I dey alive. #grateful #blessed #covid19 #f* #corona #thankful"

Comments
Post a Comment