Poloce arrest woman unto how she wounf her househelp anyhow.
Di police for Enugu don arrest 24year old woman wey don born three pikin plus join her husband wey bi 40 years old, unto say dem wounjure dem 10 year old relative wey dey stay with dem.
Investigation wey police start to dey do show say, Mrs Ozougwu wey dey live for Akomaeze street, thinkers corner for Enugu always dey torture di girl wit hot iron, iron rod, nail, she don even put peppper for di girl nyansh plenty times.
For one statement for Saturday, police public relations officer for Enugu, Mr. Daniel Ndukwe, don yarn say dem arrest dem unto how pipo wey dey di area report di mata say, how dem dey maltreat di girl too much.



Comments
Post a Comment