POCHETINNO 19-YEAR OLD SON DON SIGN NEW DEAL WIT TOTTENHAM




Maurizio Pochettino wey bi pikin of former Tottenham Hostspur Manager, Mauricio Pochettino, don sign new deal for di England club.

Maurizio wey im current deal go expire Tuesday don announce say im contract go dey extended on Monday.


For di Instagram post, E show say di 19-year-old share picture of im wit im papa wit note say "I dey wait di new season"


Maurizio or even di club sef nor tok how long di deal go dey for.

But gist dey sports data website wey im name bi transfermkt say na 2022 di deal go last reach.


Maurizio join academy of di club wey dey north London for 2017 but im still neva play for senior team yet.



Tottenham bin sack im papa wey bi Pochettino last November afta di guy don spend pass five years as coach for dia and na Jose Mourinho con replace am.


Tottenham wey dey seventh for league table now with 45points, dem use nine point take follow Chelsea wey dey 4th position for back.


Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.