NAIJA PIPO CONTRIBUTE N22M FOR CHILDREN OF OLAMIDE ALLI WEY IM FIANCE KILL BEFORE IM LATE KILL IMSELF

NAIJA PIPO CONTRIBUTE N22M FOR CHILDREN OF OLAMIDE ALLI WEY IM FIANCE KILL BEFORE IM LATE KILL IMSELF




Di murder of Olamide Alli shock lasgidi pipo as di mata happen on di 21st of June, 2020. Di mama of two pikin enta death hand unto how her Fiance, Chris Ndulue stab her before im lata poison imself.


Wen di mata happen, AGS Tribe (Accessing Grants for Startups), wey bi entrepreneurial empowerment community for women, wey Olamide bin dey part of con reason am say make dem raise N20m for di children. Within one week, dem pass di target and di money wen dem con see na N22million ontop di fund raising mata.


According to di founder of AGS Tribe, Ifedayo Durosinmi-Etti, Olamide bin don comtact di organization about her business, Pearl Academy, and dem join bodi make she for take see money set up di school.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.