IGP DON TOK SAY MAKE DEM INVESTIGATE POLICEMEN WEY ARREST LADY WEY ACCUSE D'BANJ OF RAPE.
Part of di petition read say, "On Tuesday, June 16, 2020, dem carry our client join her friend, Favour, for Lagos for her house by officers wey dey Ikeja IGP IRT. Di arrest nor get warrant and dem nor inform our client or Favour why dem arrest dem.
"As our client gist di gist, dem tell am make she write statement say she neva meet Mr Oyebanjo (D'Banj) for her life and make she still tok say na lie she lie against Mr Oyebanjo. Our client bin write am dem say make she write unto say na wetin dem go take release her bi dat before Lawyer enter di place to stop her make she nor write dat kain tin.
"Di Lawyer still con inform di policemen say, everytin wey join di rape mata of our client wey happen for December 2018 nor dey dia hand again as e don dey transferred to DIG FCID for proper investigation, for now, make dem commot hand."
DI Lawyer tell dem make dem release im client say im go dey carry am come anytime wey important for her to come.
As di petition tok, di policemen still dey try argue say Seyitan neva spend reach 24hours for dia hand so dem fit continue to dey hold her.
After dem don beg for hours, di lawyer comnot for di station, im con go back di following day.
Di Lawyer, Tommy Ojoge-Daniel, don tok say D'Banj manager, Damien Okoroafor, dey for police office di following day.
According to as di Lawyer tok, Okoroafor con dey give di policemen morale wey con make those ones refuse to release Seyitan and still dey threaten say dem go carry her enta Magistrate court make dem for fit remand her for two weeks.
Di petition still tok say "On Wednesday, June 17, 2020, di Lawyer enta di station for early momo around 7am wit application for bail wey di admin section of di IGP IRT collect.
"Di process for bail start wen one Damien Okoroafor who we con later know say na im bi Mr Oyebanjo manager enta di station con dey give officers command for inside Ikeja IGP IRT wey make di officers say dem no fit release our client.
"Dem yarn say dem wan arrange warrant from magistrate court to take detain our client for 14days. Dem seize di bail application wey di Lawyer bin submit give dem di first time. Dem still force Seyitan make she delete all di social media post wey she write about di mata say D'banj nor rape her foGlee hotel for inside Lagos for December, 2018."
Kokomaster deny di mata say make di girl con beg am make she still pay N100m

Comments
Post a Comment