FEDERAL GOVERNMENT DON YARN SAY NA NIGERIAN YOUTHS WEY DIA AGE DEY BETWEEN 20 AND 40 DEY SPREAD COVID-19 PASS AND E CON BI SAY NA DI ONES WEY OLD PASS 50 E CON AFFECT PASS
Di Director General for Nigeria Centre for Disease Control (NCDC), Dr Chikwe Ihekweazu yarn did mata for Abuja for di 48th joint national briefing of di Presidential Task Force (PTF) on top COVID-19.
"As more pipo dey carry dis virus all over di world, una go don s di number say na young pipo, no bi children now, pipo wey dey between age 20 and 40 dey spread am pass but na pipo wey don over 50 years dey suffer pass for di virus hand.
"three pipo out of five wey don die for dis COVID-19 don bi 50 years and above so we go need to work harder. all of us need make we protect pipo wey old among us.
"We wan open our airports so, we don also relax inter state travel. Our pipo get plenty love for dem family and we go see say from now, pipo go wan dey go greet dia parents, uncles, aunts and start to do burial, weddings, birthday and baptism, wey we don postpone for months.
"E dey important make we do all dis tin and inter state travel don even make am possible but make una nor forget say we never say make pipo dey gather together"

Im say as we dey plan as one country, we citizen need to remember say government neva give go ahead make we dey gather for public but we need to show love to our old pipo and make we nor expose dem to di virus.

Comments
Post a Comment