EKITI FIT RE-OPEN SCHOOL AND WORSHIP PLACES FROM JULY 17, IF...
Governor of Ekiti State, Dr Kayode Fayemi don yarn say, worship centres for di state fit start dia services from Friday, July 17, as di state government don reach agreement wit leaders of religious organizations for di state.
Governor Fayemi wey yarn dis mata on Tuesday for state-wide broadcast on di next stage of dia response to COVID-19 tok say beta arrangement don dey ground to make sure say pupils and students go fit enta school again from July 20 as stakeholders for education sector don recommend.
Im still tok say di two market wey big pass for Ado Ekiti - Oja Oba and Bisi Market wey bin dey close since go dey open for only lock up shop if dem follow wetin government tok. All di pipo wey dey sell for street plus di ones wey dey hawk for head nor dey allowed for now.
Di Governor still announce say Government don arrange Life insurance of N2.5 billion to cover N2 million each for 500 frontline medical personnel wey dey involved for COVID-19 assignment and dem don dey pay special allowances to di ones wey qualify for am.

Fayemi, still nor happy as plenty pipo still nor gree wear face mask for public wey im tok say fit increase how di virus dey spread for community.
Im tok say security agencies and Ministry of Justice get order to arrest and even prosecute any bodi wey dem catch for public place wey no wear im face mask to cover nose, mouth and chin.
As im dey explain di mata before dem fit open worship centres, space wey reach like six feet go dey between pipo, dem must wash dia hand and use face mask too.
Di number of pipo wey go enta worship centre go depend on how many pipo e go contain afta dem give each oda six feet space.
Comments
Post a Comment