APC GOVERNORS GO MAKE SURE SAY IZE-IYAMU WIN FOR EDO ELECTION - ATIKU BAGUDU - POLITICS
Di Chairman of All Progressive Congress (APC) Governors' Forum wey bi Kebbi state Governor, Abubakar Atiku Bagudu don yarn say APC governors go make sure say dia party candidate for Edo state, Pastor Osagie Ise-Iyamu go win di election wey dem go do for Edo so.
Im dey respond in top questions unto di elections wey go soon shelle for Edo and Ondo states.
Bagudu dey hope say im party go win for di elections sake of say president Buhari don get plenty achieve wey im administration don achieve.
Im say di gist wey dey fly say six APC governors dey plan to comot for di party, say na big lie. Everybodi wey hold post for di party believe wetin di party stand for.

Comments
Post a Comment