14 year old girl run commot for house go dey collect di D from 17 year old boy wey she meet untop Facebook



14-year old girl (dem nor release her name) don run commot from her parents dem house for Biogbolo, Yenagoa Local Government Area for inside Bayelsa state to go dey 'cohabit' wey mean say to dey live like husband and wife, with her Facebook lover wey Im name bi Victory and Im bi 17 years old.

Police parade Victory plus join im friend wey im name bi Gospel, for Police Headquaters, Yenagoa, for say dem keep SSS1 student for one month witout say di girl parent agree to di mata.


But we hear am say di girl wey still bi monor (she neva reach age of 18) run commot for house because she tok say her step mother nor dey treat her well for her papa house.

Di minor explain say she run comot for house go meet her Facebook friend. She nor use mouth tell her parents but she drop leta for dem as she dey comot.

She confirm am say wen she go stay wit her online friend, wey still pass her give im friend, Gospel, dem sex each oda, but nobody force her, na sometin wey dem gree put.

She still tok say "I go see my Facebook friend wey dey stay for Onopa. Wen im see me say I carry plenty bag, di guy shock, Im ask why I carry bag and wetin wan happen so, I tell am say I wan stay for one week.

"Im ask me if I sure say my parents nor go find me come, I say, no. Im con agree, we con go find hotel. We stay for di hotel for three days, after dat, we go meet im friend. Im friend carry me go Azikoro wia I con stay for one month.

"I bi 14years old. I sex im and im friend for one month. Dem nor force me to do am wit dem.  I don am intentionally."


For im own, Victory Pius, who bi from Ogbia LGA say, na from Facebook dem meet.

Im say "She bi my friend for Facebook. I neva see her before and I wan see her. I say make she come meet me for my place for Onopa. When I call am again, she say she don dey my area and I quickly go see her.


"When I go meet her, I see say she carry bags, I shock! I con tell her say, na cos say I neva see you before make me wan see you. I ask am why she come wit plenty cloth, she say she nor like di way wey her aunty take dey maltreat her and she jus wan stay wit me for one week.

"I nor too get money but I gree say make we use di small money wey dey my hand to take book hotel. My friend, Gospel show for dia too and we pay for di hotel. I dey dia wit her for two days before I go back to my house. I say make she dey go house cos I nor get money again. I no con know wetin happen afta dat time. N only three times I sex her o and my friend, Gospel con take over."

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.