Woman wey her stomach burst comot and she dey alive
Woman wey bi mama of 2 pikin don dey forced to dey live wit her intestine outside her stomach after God save am from gun attack.
Dem doctors work her stomach wit skin wey dey from her thigh, but di wound big ehn, dem no fit close di stomach until di tin heal finish.
Dem go still fix di stomach well o but na open di tin still open since di matter happen.
Di woman wey bi Takeiyah Reeves, from place wey dem dey call Newark, for inside New Jersey for America dey part of di 3 pipo wey gun wounjure for random shooting wey happen for one night club for di city for July, 2017.
Di woman stomach burst come outside after dem shoot am.
She bin dey study criminal justice wen di mata happen.
She lost like 4.5 litres of blood and her heart even stop as doctor dey try run surgery for her body. But dem succeed to remove di bullet from her bodi make she take stable.
Dem doctors work her stomach wit skin wey dey from her thigh, but di wound big ehn, dem no fit close di stomach until di tin heal finish.
Dem go still fix di stomach well o but na open di tin still open since di matter happen.
She say pipo dey always ask her if she pregnant wen dem see her and e dey always make her explain di mata.
Na volunteer work she dey do now for one group wey bi Bullets 4 Life, di one wey dey New Jersey so and she tok say after she graduate ehn, she go dey go school make she make children know say to dey use gun cause trouble no good at all.
Na dis month dem go seal her stomach wella.

Dem don run 7 surgery for her bodi so.
She say di tin bin dey make her feel bad dat year even enter depression mata for her but she don pass DAT level now and e com bi like war scar for her.
."
."

Comments
Post a Comment