Woman arrange her friend make 8 men gang rape am for Adamawa





Adamawa State Police don arrest on woman, Zainab Jafaru, wey bi 30 years unto say she dey part of group of nine pipo wey rape her 33 years old friend for Yola, Adamawa.

Zainab bin deceive her friend to wia di rapist dem dey.

D person wey dey tok for police, Suleiman Nguroje, Deputy Superintendent of Police (DSP) don yarn say Zainab deceive her friend go and she con run comot.

Nguroje yarn say "for june 13, 2020, as dem follow report of di mata wey di woma wey dem rape yarn. Inside di report she tok say group of nine pipo, eight men plus her friend wey deceive am go, wey make dem nine. Di eight men rape her for inside jambutu village for Yola North Local government. Police wey dey di area don arrest five of dem.

Di mata happen on June 12,2020, as Zainab wey dem don arrest too, deceive di victim say make she follow her go where her boyfriend dey.

As she reach dia (Zainab boyfriend) wet dem still dey find, call di oda guys, na so dem rape di lady

Di pipo wey dem do arrest and dia age bi, Ahmadu Ismail (20); Salu Buba (25); Muhammed Ali (78); Abubakar Ali (28) and Zainab Jafaru (Female) 30 years.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.