Steve Bing kill im sef as im jump from 27th floor


Steve Bing wey bi American producer, Philanthropist (persin wey dey help pipo) and writer don kill im self. Di man bi 55years. As TMZ yarn di mata, im die on Monday, June 22 afta im jump from di 27th floor of expensive apartment for Century City neighborhood for Los Angeles. Di gist bi say im bin dey suffer from depression as nobody dey wit am during quarantine.



Bing, wey bi founder of Shangri-La Entertainment inherit $600 million from I'm grandpa, Leo S. Bing,  wey bi real estate developer for L.A.

After im drop out from university, Bing follow im dream for Hollywood and im com bi di executive producer of Sylvester Stallone film wey bi "Get Carter" wey dey do for year 2000.

For 2003, im dey part of pipo wey write di action comedy film "kangaroo jack", and im still contribute for " missing in Action", Im still write one episode for "Married with Children". Di guy wey dey give pipo wella lata still invest $80 million for " The Polar Express" film wey Tom-hanks voice dey for 2004, and na Robert Zeneckis direct am.


Bing still get many films wey im produce like, "CSNY/Deja Vu", " Rock the Kasbah," "Get Carter," Girl walks into a Bar," and one Jerry Lee Lewis documentary wey den neva complete.

Bing get 2 pikin before im die. Damian Hurley wey im get from im relationship wit Elizabeth Hurley and Daughter wey bi Kira Bonder, wey di former pro tennis player, Lisa Bonded born for am.


Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.