See money wey C Ronaldo dey collect for inatagram post





Di 35 year-old, wey bi say na im get pipo wey dey follow am pass for di whole Instagram, as 222 million pipo dey follow am, don cash out 41.7 million pounds from 43 post wey pipo sponsor for di past 12 months. 

If una check am well and compare di mata, Ronaldo salary bi 27.3 million pounds for Juventus, before corona cause club to reduce dem pay.

Ronaldo wey don win five Ballon d'Or title realize excess money of about 3.5 million pounds from money wey im dey see for Instagram wey come make am bi average of 971,000 pounds per post wey dem sponsor.




For last year, Ronaldo wey some Naija pipo dey call (Ororo) don promote Nike, im perfume CR7 play it cool and one EMS training device wey dem call 'Sixpad

Messi wey bi say im and Ronaldo dey always hustle for number one for every every bi number two for dis mata as im make 25.2 million pounds, wey bi average of 631,000 pounds every time wey im post dey sponsored for Instagram.

Messi wey bi Barcelona captain get money making mata wit Adidas and im dey regulary post how im dey enjoy life too.

The picture wey show full list of how dem take make money for sponsored post for Instagram dey down so.

Comments

Popular posts from this blog

WOMAN FOR ANAMBRA AND HER HOUSEBOY DON DIE UNTO SAY DEM BURN CHARCOAL TO WARM HER ROOM

BRT fit stop work from May 25.

Ogun state don add join di 'eased lockdown' for di state.