RITUALISTS WEY DEY USE INTERVIEW KILL PIPO
This tori so, na from Nairaland di mata show face as one of di pipo wey dey di platform don tok wetin im eye see for one interview wey im go for Lagos.
I go for one interview for one place for Ikeja. As I reach dia, I see some ladies dem for front of gate, no security man dey di gate. di ladies follow me enta and dem ask how I take hear say interview dey and I show dem di message wey dem take invite me for my fone. Dey come say make I sidon for outside wia oda pipo sidon. I bi number 4 for attendance list but I see say over 10 pipo don dey dia as some even dey inside dey do wetin I nor know.
After like 20-30 mins, I con dey hear say dem dey shout for gate side, wen I reach, I see say one guy hold one of di ladies wey follow me enta wen I first enta, and di guy dey use all im voice shout say im know di lady from one interview wey im go for anoda place like 1 year ago. im tok say dem bi ritual pipo and dem dey change location make dem for no catch dem. Im tok say one of im friend die after di interview as di guy get chronic sickness wey finally kill am. Im still yarn say, im sef sick ontop di mata so, but na unto say dem quickly carry am go village to use native method run the show, if not, im for don die too. Na dia dem con tell dem say na ritual dem bin use im and im friend do.
Di guy tok say e get plenty tins wey dem dey do and how dem dey operate wey I even see am by my sef. The lady con dey beg am make e no shout.
The mata shock me, I no know wen I tear race comot di place o, I con hear lata say police don go dia go arrest dem but I no wait watch di film finish.
I pray make plenty pipo learn from wetin my eye see.

Comments
Post a Comment